Fela Kuti Follow

Mr. Grammarticalogylisationalism Is the Boss lyrics

Now listen to me now
My brothers and sisters
I beg you now listen to me now
Oh now listen to me now
My brothers and sisters
I beg you now listen to me now

They na be man
(Which man?)
Wey talk oyinbo well well to rule our land o
(That man!)

Oh yes

[Chorus]
Him talk oyinbo pass English man!

Him talk oyinbo pass America man
Him talk oyinbo pass French man
Me I say him talk oyinbo pass Germany man

The better oyinbo you talk
The more bread you go get
School start na grade four bread
B.A. na grade three bread
M.A. na grade two bread
Ph.D na grade one bread
The better oyinbo you talk
The more bread you go get

They na be man
(Which man?)
Wey talk oyinbo well well to rule our land o
(That man!)

[Chorus]
Him talk oyinbo pass English man!

Oh yes
Him talk oyinbo pass America man

Hear it!
One more time
First thing for early morning
Na newspaper dem give us read
First thing for early morning
Na newspaper dem give us read
The oyinbo wey dey inside
Petty trader no fit to know
The oyinbo wey dey inside
Market woman no fit to read
The oyinbo wey dey inside
Na riddle for laborer man

Inside the paper
Lambastical dey
Inside the paper
Ipso facto, dey that one na Latin
Inside the paper
Jargonism dey
Inside the paper
Youth delinquency dey

Who be deliquent?
Na dem be deliquent
Who be delinquent?
The oyinbo talker delinquent
Who be delinquent?
It no be me o

They na be man
(Which man?)
Wey talk oyinbo well well to rule our land o
(That man!)

Oh yes

[Chorus]
Him talk oyinbo pass English man!

Him talk oyinbo pass America man

[Fela makes up some gibberish oyinbo]

Him talk oyinbo pass Germany man
Me I say him talk oyinbo pass French man

Mr. Grammarticalogylisationalism Is the Boss Video

https://youtube.com/devicesupport: (video from YouTube)

Thanks to Makayla for submitting the lyrics.
Correct these lyrics

Comments on Mr. Grammarticalogylisationalism Is the Boss

Submit your thoughts

These comments are owned by whoever posted them. This lyrics site is not responsible for them in any way.

© to the lyrics most likely owned by either the publisher () or
the artist(s) (Fela Kuti) which produced the music or artwork. Details



All Artists A-Z

Elsewhere



© might belong to the performers or owners of the songs. Lyrics may be used for private study, scholarship or academic research only.
In accordance to the Digital Millenium Copyright Act, publishers may ask to have specific lyrics removed.
This is a non-commercial site. We are not selling anything. Details
Lyricszoo content, design, layout © 2024 Lyricszoo.